My people, make we leave English matter talk am as in be; Make I talk am straight;
DRUGS NO BE CRUISE.
E no be show of levels.
Na slow poison.
Na thief.
E dey steal your future small-small.
And if you no wise up, one day, you go open eye and realize say your mates don dey drive destiny,
you still dey drag drugs.
I no come here to form. I come speak to you like sister wey care about the future of Nigeria Youths.
Many of una dey take drugs because of pain, frustration, peer pressure, even hunger.
But hear me: solution no dey for inside bottle or white powder.
Solution dey your head. E dey your decision.
You be king. You be queen.
So why you dey use drugs take kill your crown?
No let anybody deceive you.
No drug go make you powerful.
E go only make you pitiful.
Today na just small high.
Tomorrow, you don lost focus.
Next tomorrow, you no even sabi yourself again.
I don see boys wey get sense turn to shadow.
I don see girls wey get bright future turn to beggar.
All because of that one wrong turn.
That one “just try am” moment.
Abeg, I dey beg you:
No be every invitation you go answer.
No be every corner you suppose waka enter.
No be everything wey dey trend go make sense.
Your life sweet pass drugs.
Your future big pass highness.
Your dream strong pass peer pressure.
As I dey talk now, many parents don cry,
Think of your papa, mama, sister, brother, friends.
Many talents don waste.
Many youths don die young and they die for nothing.
But you, yes you wey dey hear me now;
“ no be you dem go count loss”.
You go rise.
You go lead.
You go succeed clean, head straight, hands clean, focus tight.
Say NO to drugs; not because dem talk say make you say no… but because YOU get something bigger to live for.
The world dey wait for your greatness.
Nigeria dey wait for your voice.
No dull am. No kill am. No waste am.
I believe in you.
We believe in you
Make you believe in yourself too.
God bless Cerany
God Bless Naada
God Bless NDLEA
God Bless NAFDAC
God Bless EFCC
God Bless NPF
God Bless The Armed Forces
God Bless Chioma Lynda Onwuka
God Bless Federal Republic of Nigeria 🇳🇬
Thank you